Mohbad is dead: Olamide, Tacha, odas react to tori of singer Ilerioluwa Oladimeji Aloba death

by 24britishtvSept. 12, 2023, 10:01 p.m. 26
-

Ogbonge musician and record label YBNL CEO Olamide Adedeji wey many pipo sabi as Olamide don react to di tori wey dey fly up and down about di death of musician Ileriooluwa Oladimeji Aloba wey pipo sabi as Mohbad.
Na on Tuesday evening, tori begin trend on social media say di Nigerian artiste, don die.
Di Nigerian rapper and music producer, Olamide bin post for X say “Damn! Mohmad" and add heart break emoji, e also post say "Dis life".
Dis na afta tori of di death of di 27-year-old begin spread for Twitter.
Reality TV star Tacha also post about di tori.
End of Recommended articles
Details of di tori neva clear and no official confirmation don come out from im management or family.
However, plenty of im fans, oda musicians and Nigerians don dey react to di tori of im death as dem mourn and send tribute on social media.
One of im colleague, Emeka Akumefule, aka Blaqbonez post on X say, "RIP Mohbad, may you find peace."
Mohbad bin dey under Naira Marley “Marlian Records” but e comot di label for 2022.
E popular for im hit songs wey include Ponmo, Feel Good, and KPK (Ko Por Ke) wit Rexxie wey dem nominate three times for 2022 Headies awards.
Screenshot of Olamide reaction
Mohbad na one of Nigeria rising musician. Dem born am for Lagos state, Nigeria for June 1996.
E bin sign under Naira Marley, “Marlian Records” but e comot di label for 2022 in di middle of some controversies.
For inside one recent interview e do wit former Reality TV star Tacha wey also be radio host, Mohbad bin tok about im relationship wit Naira Marley.
Tacha share clips from di interview few hours afta tori of im death break.
E tok for di interview say, “ We just split from Marlian music to Imolenization, we just wan be on our own but e no come easy."
E say e no easy but im dey find im way. E add say dem no dey fight and tins dey cool between dem.
Mohbad bin release im first album, Light EP for 2020. E dey popular for hit singles like Ponmo, Feel good and Ko Por Ke wit Rexxie.
E also don do collabo wit artiste like Bella Shmurda, Small Doctor, Zlatan, among odas.
2023 BBC. De external site no concern BBC.

-

Related Articles

HOT TRENDS

Boiling Point: this nailbiting kitchen drama is British TV at its finest

by 24britishtvSept. 30, 2023, 8 a.m.2
HOT TRENDS

by 24britishtvSept. 30, 2023, 1 a.m.2
HOT TRENDS

Fair Play to Boiling Point: the seven best films to watch on TV this week

by 24britishtvSept. 30, 2023, midnight2
HOT TRENDS

Stephen Graham's incredible offer to adopt child co-star after tragedy

by 24britishtvSept. 30, 2023, midnight2
HOT TRENDS

Clarke scores twice in Sunderland win at Sheff Wed

by 24britishtvSept. 29, 2023, 10 p.m.2
HOT TRENDS

Barca sever Sevilla ties after directors' boycott

by 24britishtvSept. 29, 2023, 10 p.m.2
HOT TRENDS

FC Barcelona Vs. Sevilla: Huge Lineup Changes From Xavi

by 24britishtvSept. 29, 2023, 9 p.m.2
HOT TRENDS

New York City: State of emergency declared over flash flooding

by 24britishtvSept. 29, 2023, 8 p.m.2
HOT TRENDS

Fury to face Usyk in undisputed title fight in Saudi

by 24britishtvSept. 29, 2023, 8 p.m.2
HOT TRENDS

Mourinho on 'worst-ever' start: 'No time to cry'

by 24britishtvSept. 29, 2023, 8 p.m.2
HOT TRENDS

Dianne Feinstein: 'Pioneering' Senator dies aged 90

by 24britishtvSept. 29, 2023, 8 p.m.2
HOT TRENDS

Calvin Robinson suspended as GB News presenter

by 24britishtvSept. 29, 2023, 6 p.m.2
HOT TRENDS

Sources: Fury, Usyk sign deal for winter clash

by 24britishtvSept. 29, 2023, 6 p.m.2
HOT TRENDS

GB News: Calvin Robinson becomes third presenter suspended

by 24britishtvSept. 29, 2023, 3 p.m.2
HOT TRENDS

M53 crash: Major incident as school bus full of children overturns

by 24britishtvSept. 29, 2023, 2 p.m.2
HOT TRENDS

Will there be a Castlevania: Nocturne Season 2?

by 24britishtvSept. 29, 2023, 1 p.m.2
HOT TRENDS

Tickets on sale for Take That show at the Swansea.com Stadium | Swansea

by 24britishtvSept. 29, 2023, noon2
HOT TRENDS

All-time teams for Europe, U.S.

by 24britishtvSept. 29, 2023, 8 a.m.2
HOT TRENDS

Today’s Wordle #832 Hints, Clues And Answer For Friday, September 29th

by 24britishtvSept. 29, 2023, 8 a.m.2